Akara na one popular nigerian food way we fit eat in the morning as breakfast or we fit eat am anytime we like. so for this foodie Saturday i go teach una how to make akara. lets go there.
The things way them they use make Akara na
1 2 cups of beans
2 1 onions
3 red pepper
4 crayfish
5 groundnut oil
6 maggi or any cube you want use
How to prepare am
wash and soak the beans overnight inside water then you come wash the beans till the back comot then you come ground the beans with blender then you add the pepper and onions come blend everything together then you come pour the beans inside deep rubber plate then you come use turning stick take turn am well well until the beans come dey light as if e no get weight again.then you come add maggi, salt, and crayfish if you like then come turn am again. After you don turn am finish, you come put your groundnut oil for fire and allow the oil to hot well well then you come they put the mixture of akara inside the hot oil with deep cooking spoon small small. when the akara don dey turn brown,you come turn am to the other side make e brown too when all that set don brown,you comot am for fire come put another set until that set done. you fit enjoy your akara with bread and akamu. Enjoy.
abeg share this post.
No comments:
Post a Comment